Close Menu
Invest Insider News
    Facebook X (Twitter) Instagram
    Monday, December 15
    Facebook X (Twitter) Instagram Pinterest Vimeo
    Invest Insider News
    • Home
    • Bitcoin
    • Commodities
    • Finance
    • Investing
    • Property
    • Stock Market
    • Utilities
    Invest Insider News
    Home»Finance»Ghana finance minister mid-year budget review: Mohammed Amin Adam say Ghana economy dey rebound
    Finance

    Ghana finance minister mid-year budget review: Mohammed Amin Adam say Ghana economy dey rebound

    July 23, 20245 Mins Read


    Wia dis foto come from, MINISTRY OF FINANCE/FACEBOOK

    Wetin we call dis foto, Di finance minister Dr Amin Adam tok say goment to re-introduce road tolls afta dey cancel am in 2021

    26 minutes wey don pass

    Ghana finance minister Dr Mohammed Amin Adam don tok say goment no dey ask for more money to finance goment activities as im present mid-year budget for parliament.

    Di minister say goment “go dey efficient and strategic to promote growth.”

    For election year, successive goments don dey spend more money but dis time di minister say “we go live within our means wia dey consistent wit di $3bn IMF programme di kontri dey under.”

    Bifor di presentation, sabi pipo and oda Ghanaians don tok say goment gatz to scrap some taxes wia dey pressure di pipo.

    For some, di Covid 19 levy wia dey impose 1% charge on all goods and services for Ghana as well as imports, gatz to go as di world don deal wit Covid 19 disease since 2021.

    Already pipo don dey pay National health insurance levy (NHIL), GETFund levy, customs and excise duties on products, property rates, stamp taxes, payroll taxes, communication service tax, emissions levy, electronic transactions levy among oda taxes.

    But di finance minister neva announce say dey remove any tax.

    Dis na some of talking points from di presentation of di mid-year budget for parliament.

    Goment don receive third tranche of $360m for di IMF

    Di minster oga Mohammed Amin Adam tok say “goment don conclude di second review of di extended credit facility wit di IMF wia make dey release di 3rd tranche of $360m to di kontri.”

    Wit dis money, di IMF now don give Ghana a total of $1.6bn out of di $3bn wia dem agree to give to di kontri to revive di economy wia don dey inside crisis.

    “We don complete di debt restructuring program wit di official creditor committee wey result in $2bn debt relief – dis mean say Ghana neva go service our debt to our official creditors from 2023 to 2025.”

    Goment go re-introduce road tolls for 2025

    Di roads ministry under di minister Kwasi Amoako-Atta don cancel road tolls in 2021.

    Pipo wia don dey work for dis tollbooth across di kontri lose dia jobs – dis pipo na pipo wey gatz disability.

    Di speaker of parliament don tok at di time say di minister neva gat di right to cancel road tolls since im neva carry go parliament.

    Goment tok at di time say dem go raise more dan di Gh ¢ 70m ($5m) wia di road tolls dey generate evri year thru di electronic transactions/transfer levy wia don dey charge 1.5% for every electronic transaction.

    Despite di pressure from sabi pipo and odas say make goment carry di toll system come, dem tok say dey neva go do am.

    But three years afta, di finance minister tok say goment don dey re-introduce di road tolls for 2025.

    Di minister tok say “goment don give green light for di development of structure wey go make we implement road and bridge tolls for 2025.”

    Dis na u-turn for di Nana Akufo-Addo goment, as dey continue to dey try to raise revenue to fund goment activities.

    Goment go release 1.5bn Ghana cedis ($97 m) bailout funds

    Customers of some fund management companies wia goment don shutdown bin dey protest say make goment pay dia locked up funds since 2018.

    Goment thru di bank of Ghana close down di companies say dey neva renew dia license wey dey neva dey follow rules wia di central bank don give.

    Many pipo don lose dia moni for dat shutdown wia dey now bin dey pressure goment to pay dia money.

    Convener of di Gold Coast fund management customers tok say many of dia members don die since dey neva fit access dia money for dis companies.

    Charles Nyame tok say “goment don dey insensitive wia we dey wonder how we go pay for medical bills and oda tins since our money don lock for six years.”

    Im add say “we trust di system wey we invest our moni to secure our future na so goment don do we like dis – we no fit dey feed ourselves.”

    Di group threaten say dey go campaign again di goment if dey no pay dia moni.

    But as im dey deliver di midyear budget, finance minister oga Amin Adam tok say “cabinet don approve 1.5bn Ghana cedis ($97 m) to settle outstanding claims wey dey relate to di financial management companies.”

    Goment dey target inflation go decline to 14%

    Di finance minister tok say inflation don dey decline as goment bin dey put in measures to deal wit di economic crisis.

    Im also add say di exchange rate don stabilise despite di pressure wey dey di system.

    “Di 18.9% depreciation rate to di US dollar as of June 2024 bin improvement ova di 22% wey di kontri record for di same period last year.”

    Im add say “inflation at di end of June bin dey 22.8 % ,” na reduction from di 42.5% wia di kontri don record for June 2023 according to di statistical service.



    Source link

    Share. Facebook Twitter Pinterest LinkedIn Tumblr Email
    Previous ArticleBitcoin Miners Return to Profitability as BTC Continues Market Recovery: Bitfinex
    Next Article Sale of school property delayed

    Related Posts

    Finance

    Move to avail of €100m EU loan for defence spending was blocked by Department of Finance – The Irish Times

    December 12, 2025
    Finance

    Ripple (XRP) vs Mutuum Finance (MUTM): Which is the best crypto to buy now for a 5,000% profit?

    December 10, 2025
    Finance

    What Finance Can Do Differently In 2026

    December 10, 2025
    Leave A Reply Cancel Reply

    Top Posts

    How is the UK Commercial Property Market Performing?

    December 31, 2000

    How much are they in different states across the US?

    December 31, 2000

    A Guide To Becoming A Property Developer

    December 31, 2000
    Stay In Touch
    • Facebook
    • YouTube
    • TikTok
    • WhatsApp
    • Twitter
    • Instagram
    Latest Reviews
    Investing

    Seres Therapeutics executive sells stock for $2,749 By Investing.com

    October 29, 2024
    Stock Market

    Stock market today: Wall Street climbs as Big Tech recovers following worst week in months | Business

    July 22, 2024
    Stock Market

    S&P 500 falls amid tariff uncertainty, spiking US bond yields

    September 2, 2025
    What's Hot

    Property sales slump 66% in April following stamp duty deadline: HMRC

    May 30, 2025

    Does a new proposal have the teeth to bring property tax relief to Topeka?

    July 20, 2024

    Is Bitcoin Ready for a Surge with the Shutdown Deal Coming?

    November 11, 2025
    Most Popular

    Green shoots for UK residential investment says globa…

    August 19, 2024

    Le dollar baisse, le Bitcoin monte, c’est la potion magique de Donald Trump

    April 21, 2025

    Liberty Utilities responds to ACC questions after asking customers to conserve

    August 16, 2024
    Editor's Picks

    Surprising state where international buyers are scooping up property despite a looming crash

    June 6, 2025

    3 Reasons to Buy Bitcoin Before the End of the Year

    November 22, 2025

    Commodity prices mixed last week amid trade war concerns

    March 10, 2025
    Facebook X (Twitter) Instagram Pinterest Vimeo
    • Get In Touch
    • Privacy Policy
    • Terms and Conditions
    © 2025 Invest Insider News

    Type above and press Enter to search. Press Esc to cancel.